Belgium vs Ukraine: Kevin de Bruyne team and Romania, Slovakia enta knockout stage of Euro 2024 - BBC News Pidgin (2024)

Belgium vs Ukraine: Kevin de Bruyne team and Romania, Slovakia enta knockout stage of Euro 2024 - BBC News Pidgin (1)

Wia dis foto come from, Getty Images

Romania and Belgium don qualify for di R16 of di Euro 2024 tournament afta both teams draw for dia third group games.

Belgium and Ukraine game end 0-0 wia Slovakia and Romania also end 1-1.

Bifor dis round of games, all four teams gat 3 points from two games.

Na so di teams gatz to avoid defeat to stand chance to progress.

Wit di results, Romania finish first on di table wit 4 points same as Belgium - only say di red devils dey second.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

Slovakia wit 4 points gatz chance to progress if dem check di best third-place teams across di groups.

Belgium begin di game on di front foot bifor Ukraine come enta dia own but dem no fit to create any beta chances for goal.

Some chances begin to flow bifor halftime but none of di two teams fit breach di goal.

In di end, both teams settle for goalless draw wey mean say Belgium qualify wit 4 points at second place.

Ulkraine gatz to pack dia tins and leave despite say dem too gatz 4 points from three point.

Match highlights

Ukraine don comot di tournament.

Referee blow whistle for di end of di game hia.

Slovakia and Romania also end 1-1.

92" Belgium win corner. Dem take am short and win anoda corner bifor De Bruyne take go for goalkick.

Slovakia and Romania also dey play 1-1 at dis time.

91" Ukraine break into di Belgium area but di shot dey straight at di keeper.

90" Mangala wan penalty but referee say no penalty!

89"Lukaku don comot wia Lois Openda replace am.

87" CHAAANCE! Ukraine also get their chance but Castagne put im body for ground top block di ball.

86" CHAAAANCE! Belgium break forward 3 v 2 but di pass to Bruyne dey behind am but im dey available to pass back to Bakayoko. Im blast am ova.

85" Bakayoko don try to cross di ball afta im beat im marker but Ukraine clear.

84" Dis closing stage na tricky - as coach you go hold on and win or you go try to score for di last minute? Make we know

83" Di players don dey taya, wia dem, dey fall fall for ground.

82" Casteel don make one ogbonge save from a corner - di ball dey sneak into im near post directly from di corner.

81" Ukraine win corner from Vertonghen im tackle.

77" CHANCE! Dovbyk and di oda fans for stadium tink say im shot enta di net. But dat ball na side-netting

76" Yohan Bakayoko don dey enta for Belgium. Doku dey comot.

Di last few minutes don come alive wit both teams creating chances.

72" On di oda side, Ukraine get 2 v 2 chance but Dovbyk delay on top of di ball til di chance don miss.

71" CHAAANCE! Carrasco tink say im score wit im shot inside di box but Ukraine keeper don save di ball, Doku try to shoot but dem block im ball.

70" Slow buildup for di back by Belgium but im no dey go anywhere.

Belgium vs Ukraine: Kevin de Bruyne team and Romania, Slovakia enta knockout stage of Euro 2024 - BBC News Pidgin (2)

Wia dis foto come from, Getty Images

68" Dovbyk get yellow card afta im pull Onana im jersey for midfield. Ukraine now dey make three straight changes.

66" CHAAANCE! Carrasco waste one good chance afta Lukaku don play am on. De Bruyne dey close wia im for pass to am, but Carrasco try to score but Ukraine defender come block di ball.

De Bruyne don vex.

64" CHANCE! Lukaku grab ball enta di box but im left foot shot dey weak, keeper don carry am.

61" Tielemans and Trossard dey commot.

60" Yannick Carrasco and Mangala dey prepare to enta park.

58" Belgium begin to dominate di ball once again bifor Ukrain striker Dovbyk enta offside trap. Referee don blow for offside.

56" Zinchenko don dey come on to replace Mykolenko. But bifor dat go happun Belgium try to create anoda chance but Doku im cross miss everybody including Lukaku.

54" Belgium win corner! Ukraine players dey throw dia bodies to block di shots; one from Doku don strike Mykolenko.

53" Di midfield don choke - nobody dey fit string togeda correct passes for dia.

52" From di corner di ball don fall to Tielemans again - dis time di Aston Villa player blast am ova di bar.

51" Tielemans don blast one shot from outside di box afta Doku make anoda poor pass into di box. Im win corner.

50" Ukraine don win throw for di right hand corner of di Belgium area. Di throw ball don cause wahala inside di area but di chance don vanish.

47" Early quick chance for Belgium thru De bruyne and Doku but Ukraine clear dia lines.

46" Both teams emerge for di second half.

Belgium vs Ukraine: Kevin de Bruyne team and Romania, Slovakia enta knockout stage of Euro 2024 - BBC News Pidgin (3)

Wia dis foto come from, Getty Images

Referee blow for halftime!

46" As di halftime don dey reach, both teams dey try grab a goal but so far none of dem dey successful.

44" De Bruyne gat chance to test di Ukraine keeper wit im shot. Di keeper don save am simple.

42" First yellow card of di game for Faes as im foul im marker for di Belgium area.

41" So far di chances dey few until Ukraine get chance inside di Belgium box. Instead say Yaremchuk go shoot on goal, im try to pass to Dovbyk, wey di chance vanish.

40" De Bruyne fly di freekick into di area wey Ukraine clear.

38" Free-kick to Belgium midfielder Onana in front of di Ukraine area.

All di four teams gat 4 points at dis stage - Romania dey lead, Belgium dey second, Slovakia dey third and Ukraine dey fourth.

Update for di oda game - Romania don equalize thru a penalty by Razvan Marin. Slovakia 1 - 1 Romania.

34" Di last few minutes both teams don dey foul dia opponents.

32" De Bruyne try to catch di Ukraine keeper for im first post wit di free-kick - di ball dey close.

31" Bifor De bruyne go play di freekick, im go tok di ref say dem dey use laser for im eyes from di stands.

29" Belgium dey try create sometin for here. But Lukaku don win freekick for di Ukraine area.

Belgium vs Ukraine: Kevin de Bruyne team and Romania, Slovakia enta knockout stage of Euro 2024 - BBC News Pidgin (4)

Wia dis foto come from, Getty Images

27" CHAAANCE! Ukraine fluff dia lines, afta dem catch belgium 3 v 1 for di back but Dovbyk delay for di ball wey im pass for Sudakov mean say im gatz no oda option dan to blast di ball ova ti top.

Slovakia don score for di oda game against Romania. Ondrej Duda wit di goal on 24 minutes. Wit dat goal Slovakia don go top wit 6 points as tins stands.

24" Belgium don dey put pressure under Ukraine. Onana, Doku and De Bruyne all dey shake dem for back, but di chances no test di keeper.

22" Theate from Belgium shoot from outside di box afta dem create some fine passing sequence. But di ball fly wide.

21" Right afta di ball return to midfield, Ukraine push forward against - dis time Dovbyk wey shoot from far but di ball go wide.

20" CHAAANCE! Ukraine manage to move forward wit a Yaremchuk shot from distance. Casteels don save am afta di second attempt.

19" So far both teams dey careful wit dia passes.

16" Doku gat di ball wey im drive across di pitch bifor im pass to De Bruyne. But im pass deflect for throw ball.

15" Ukraine don dey string togeda some passes - but di final ball always dey let dem down.

13" Corner to Belgium. But Zabarnyi head ova for anoda corner.

11" Belgium dey buil up patiently bifor Onana thread di ball inside di channel for De Bruyne but di Manchester City midfielder no fit to reach dat ball.

10" Ukraine dey burst forward thru Mykolenko but im turn back carry di ball give im teammate.

9" Ukraine dey struggle to contain di quick passing from Belgium - Doku don win freekick for di center.

Di oda game between Romania and Slovakia also dey happun wit di score at 0-0 afta 11 minutes.

6" Kevin De Bruyne carry di ball wey im drive towards di Ukrain area wey im play one thru ball to Lukaku. Di striker im weak shot neva trouble Trubin

4" Tielemans, Onana, Trossard all pass pass di ball among dem for di Ukraine box im front bifor dem pass to Lukaku. Di AS Roma player no fit to reach dat ball.

3" De Bruyne thread one cute pass towards Doku but Ukraine clear.

2" Belgium don dey control di game for dis early stage but Ukraine dey put pressure dey hassle for every ball.

1" Di corner neva trouble Belgium. Dem now try to pass di ball for dia yard bifor a long ball towards Doku don run too far.

1” Afta di kick-off, Ukraine don begin to attack Belgium wia dem win corner.

Referee don blow whistle for di game to begin

Di stadium dey packed wit fans wey wan enjoy football.

Di red devils of Belgium dey wear dia blue jersey ova wine shorts as Ukraine dey dia traditional yellow jersey.

Di two teams don finish warm up wia dem waka come di pitch – to sing dia anthems bifor di game go begin.

Greetings pipo. Welcome to di live text commentary for dis crucial Euro group E clash between Belgium and Ukraine.

Ukraine vs Belgium line-ups

Belgium XI: Casteels (GK); Thaete, Faes, Vertonghen, Onana, Castagne, Tielemans, De Bruyne, Trossard, Doku, Lukaku

Ukraine XI: Trubin (GK); Svatok, Yaremchuk, Zabarnyi, Sudakov, Mykolenko, Brazhko, Shaparenko, Matviyenko, Tymchyk, Dovbyk

Belgium vs Ukraine: Kevin de Bruyne team and Romania, Slovakia enta knockout stage of Euro 2024 - BBC News Pidgin (2024)
Top Articles
Latest Posts
Article information

Author: Jeremiah Abshire

Last Updated:

Views: 6424

Rating: 4.3 / 5 (54 voted)

Reviews: 93% of readers found this page helpful

Author information

Name: Jeremiah Abshire

Birthday: 1993-09-14

Address: Apt. 425 92748 Jannie Centers, Port Nikitaville, VT 82110

Phone: +8096210939894

Job: Lead Healthcare Manager

Hobby: Watching movies, Watching movies, Knapping, LARPing, Coffee roasting, Lacemaking, Gaming

Introduction: My name is Jeremiah Abshire, I am a outstanding, kind, clever, hilarious, curious, hilarious, outstanding person who loves writing and wants to share my knowledge and understanding with you.